Mohamed Salah: Liverpool forward say di club dey ‘throw am under di bus’

Wia dis foto come from, Stu Forster/Getty Images
Article Information
-
- Author, Neil Johnston
- Role, BBC Sport journalist
-
49 minutes wey don pass
Mohamed Salah say e dey feel like im club Liverpool dey “throw am under di bus” and im relationship wit di head coach Arne Slot don break down.
Salah na part of di substitutes wey dem no use for Saturday 3-3 draw at Leeds United. Dat na di third straight game wey di Egypt forward don start on di bench.
Afta di game, di scorer of 250 goals for 420 Liverpool appearances tok for interview wit journalists: “I tink e dey veri clear say someone want make I get get all of di blame.
“I say many times bifor say I get good relationship wit di manager, and all of a sudden we no get any relationship.
Kontinu to dey read
“I no know why but e seem to me, how I see am, say someone no want me for di club.
“E seem like di club don throw me under di bus. Dat na how I dey feel. I tink e dey veri clear say someone wan make I get all of di blame.
“Dis club, I go always support am. My kids go always support am. I love di club so much and I go always love am.
“Di situation no dey acceptable to me, to be fair. I no get am. E be like dem throw me more under di bus. I no tink I be di problem. I don do so much for dis club.
“I no suppose go evri day to fight for my position becos I earn am. I no dey bigger dan anyone but I earn my position. Na football. Na wetin e be.”
Salah, wey dey also go to di Africa Cup of Nations for 15 December 2025, add say e dey unsure about im Liverpool future, despite signing new two-year contract in April.
Play video, “Archive: Some of Mohammed Salah’s best goals for Liverpool”, Duration 2,2302:23Wetin we call dis Video, Archive: Some of Mohamed Salah best goals for Liverpool
Salah, wey be 33, score 29 times for di 2024-25 Premier League as di Reds win di title for Slot first season in charge.
Howeva e don struggle for form since Liverpool no fit match di kain heights wey dem get last term.
Salah, wey dem bring to di club from Roma by Jurgen Klopp for 2017, don score just four times for 13 top-flight appearances dis season.
Di Saudi Pro League don get ambitions to add Salah to dia league – and na arguably di most recognisable Middle Eastern player on di planet – to a roster of global superstars wey include di likes of Cristiano Ronaldo and Sadio Mane.
Sources don indicate say Al-Hilal, managed by Simone Inzaghi, dey among di teams wey dey interested for Salah.
Dem tell BBC Sport say Liverpool dey open-minded about Salah future amid di Saudi interest.
Afta di Leeds game – wen Liverpool lead 2-0 and den 3-2 bifor dem conceded 96th-minute equaliser – Slot tell Sky Sports why e no use Salah off di bench.
“E dey more about controlling di game [3-2] and we no need a goal,” Slot say bifor Salah interview.
“Normally wen you need a goal, like last week against Sunderland, I bring Mo enta.”
For di pre-match news conference on Friday, Slot say e understand di talk wey surround Salah afta dem drop am from di team.
“Di chatter, yes, becos e deserve dat, e also dey influential for me and [for] six or seven years. E dey completely normal for pipo to tok about am wen e no dey play,” Slot add.
Salah, third on Liverpool all-time list of scorers behind Ian Rush (346) and Roger Hunt (285), make im most recent start for di 4-1 Champions League home defeat by PSV Eindhoven on 26 November.
If Mohamed Salah bin play im last game for Liverpool, den di ‘Egyptian king’ go still go down as a Liverpool legend.
Since e sign for £34m from Roma for 2017, di 33-year-old don score 188 goals for di Premier League alone.
Only Alan Shearer (260), Harry Kane (213) and Wayne Rooney (208) get more dan Salah 190 goals for di Premier League – e score two for Chelsea during im time dia for 2013-14.
Dem name Salah as di PFA players’ player of di year for last season afta e score 29 goals and adding 18 assists on im way to di Golden Boot and Liverpool title.




