Trends-CA

Nigeria vs Gabon: Osimhen, Aubameyang go jam for 2026 Africa World Cup qualifying play-offs match for Morocco

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Victor Osimhen of Nigeria and Pierre-Emrick Aubameyang of Gabon

31 minutes wey don pass

Na hours remain for di Super Eagles of Nigeria to face dia opponent Gabon for di 2026 Fifa World Cup Africa Qualifying Play-offs.

Di Moulay El Hassan Stadium go host dis opening match for Rabat, Morocco on Thursday wey be 5pm Nigerian time.

Anybody wey win dis match go enta di Africa play-off finals wey dey happun on Sunday.

Nigeria and Gabon finish as best second placed kontris for the Africa qualifiers Group stage.

Head to Head

Di Super Eagles dey show Gabon pepper for some of di matches wey dem don play bifor.

Dem bin jam nine times but Nigeria win five out of di nine, dem draw three and lose two.

E mean say inside dia nine meeting Gabon win only two times.

Dis match go tough for di two kontris and dem get beta players wey fit do di work .

Nigeria front man Victor Osimhen and ogbonge player Pierre-Emerick Aubameyang go meet face to face.

Both coaches dey also hope say dem go qualify fof di play-off final.

Which attack or defence go win, we go know afta 90 minutes of play.

Wia dis foto come from, Nigeria Super Eagles

Wetin we call dis foto, Foto of Super Eagles during training on Wednesday for Rabat, Morocco

Nigerians bin dey worry about di performance of di Super Eagles for dis play-offs especially afta dem boycott training session on tuesday sake of unpaid bonuses and allowances.

BBC News Pidgin go bring una live text update as di match dey go on, kick-off na 5pm Nigerian time

Related Articles

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Back to top button