Nnamdi Kanu found guilty: Justice James Omotosho call Ipob leader international terrorist, find Kanu guilty of terrorism

Play video, “Nnamdi Kanu Judgement: Judge order removal of Ipob leader from court”, Duration 3,0503:05Wetin we call dis Video, Nnamdi Kanu Judgement: Judge order removal of Ipob leader from court20 November 2025, 08:38 WAT
New Informate one hour wey don pass
One court for Nigeria don sentence separatist leader Nnamdi Kanu to life imprisonment afta dem find am guilty of terrorism. Dis dey come 10 years afta dem bin first arrest am.
Justice Omotosho for im ruling say di suspect no show remorse throughout the trial.
Di court tok say e dey satisfied say Kanu bin make plenti broadcasts to ginger kasala and killings, as e bin dey part of im campaign for a different kontri for south-east Nigeria wey dem call Biafra.
Kanu dey convicted of all seven charges wey dem sama am wit as di judge still dey give im judgement.
Kanu bin no blow till 2009 wen e bin start Radio Biafra, wey be station wey bin dey call for independent state, for di Igbo Pipo wey dem broadcast give Igbo pipo for Nigeria from London.
How drama hapun for Nnamdi Kanu Judgement Day case
Wen dem ask make Nnamdi Kanu make e comment on im mata, di Ipob leader ask say why dem put am for detention wen e no commit crime.
Kanu say make dem grant am bail.
“Wetin I dey ask for na referral to di appeal court for dis case. Why I go dey for detention for law wey no exist. I wan make dem grant me bail.”
Di judge say di referral to appeal court and stay of proceedings no go dey entertained as e dey for di administration of criminal justice law.
“Dis court no go entertain am. On di bail application, by di order of dis court on 27 October 2025, court make order make di defendant file im defence for final address. Na based on dis, di issue dey dismissed.”
Wen di judge bin wan give di judgement, Kanu bin cut in and say make di judge show am for law wia e commit any crime.
As di judge wan tok, Kanu shout on am say make e show am di law wey e wan use deliva di judgement.
Wen di kasala dey go on, Kanu begin shout while di judge bin wan tok. Na so di judge say make dem carry Kanu comot for di court room.
Kanu no stop to dey shout as e dey vex, e also ask make di securiti no touch am.
Di judge say Kanu get chance to appeal afta di judgement, but Kanu kontinue dey tok.
“You no sabi law, show me di law. Any judgement for dis court na rubbish,” Kanu tok as e vex.
Di judge say make dem go on short break, and di court bin go for short break.
Dem resume back from di break, but Kanu no enta.
According to di judge, e say dem give Kanu opportunity to defend imsef but e misuse am.
Di judge further add say e dey inside law say if anyone bin disturb di courtroom, dem fit do di judgement for im absence.
“Fundamental right no dey absolute, na opportunity. If dem give you di opportunity and you no use am, you no fit claim a breach. Di defendant no use di opportunity wey we give am.”
“E dey law say if defendant misbehave for di courtroom, di judgement fit go on witout am.”
“I hereby make an order sake of di unruly behaviour of di defendant, di judgement go proceed for im abence.”
Summary of Kanu trial so far
Di trial judge give di Nigeria govment exact days for dem to start dia case, call dia witnesses and close dia case, and Adegboyega Awomolo – Senior Advocate of Nigeria – wey be lead counsel for di prosecution, meet di deadline.
Some of di evidence na video and audio recordings of some of Nnamdi Kanu broadcasts, including di ones wia e dey ginger im followers make dem attack and kill army and police pipo, make dem destroy public properties, and also clips wia e threaten pipo for di southeast region of Nigeria to obey im sit-at-home orders.
For im own part, Nnamdi Kanu and im lawyers wey di lead counsel na former Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Kanu Agabi, bin first file a no-case submission.
Dem ask di court to trowey all di charges against Kanu bicos according to dem, di prosecution no establish any case against dem.
Howeva, Justice Omotosho overrule di no-case submission as e tok say Kanu get some explanations to do sake of di evidences wey di prosecution bin show for court.
Na for dis stage of di trial mata change and trial wey bin dey go on schedule start to dey break.
Den afta some adjournments to give Kanu some time to get di case file and prepare to defend imsef, for di next hearing date, di Ipob leader tell di court say im find out say di charges against im no dey valid so diafore e no get case to ansa.
Kanu insist say di laws wey di Nigeria govment bin base di charges against am don dey repealed, wich mean to say dem no dey exist again and so make Justice Omotosho discharge am.
But di trial judge beg Kanu several times say di trial don pass di stage wia di defendant go dey raise all kinds of interlocutory objections. Omotosho say any objection wey Kanu raise, im go consider dem for im final judgement, but make Kanu first put in im defence.
Afta about six adjournments wey Justice Omotosho dey explain to Kanu di implications if e refuse to enta im defence, di judge rule say Kanu don waive di opportunity to talk im own side of di story, so e adjourn for judgement.
Days afta, Kanu file case for appeal court and ask dem to order di high court to hold on wit di proposed judgement and first of all determine di issues of jurisdiction and repealed laws wey im raise.
One of Kanu former lawyers tell BBC News Pidgin say as im don file dat suit for di Court of Appeal, di lower court no get any oda choice except to wait until di appeal court don deliver dia ruling.
But anoda lawyer wey get knowledge of di mata tell our tori pesin say dat suit wey Kanu file for appeal court no go stop Justice Omotosho from delivering im judgement on 20 November.
Dis lawyer wey plead anonymous say di suit wey Kanu file for Court of Appeal no dey based on any specific pronouncement or ruling or judgement of di trial court, so di higher court no fit grant a stay of proceedings.
BBC Pidgin tanda wella for court to bring you updates on weda di judgement go happen dis Thursday or not.
Di seven counts court find Nnamdi Kanu guilty of
- Count 1: Say you Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population.
- Count 2: Say you Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order.
- Count 3: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you declare your sef as member and leader of Ipob, group wey Nigeria goment don ban.
- Count 4: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage members of di public to kill Nigeria security officers.
- Count 5: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage di public to attack officers of di Nigeria police force.
- Count 6: Say you Nnamdi Kanu make broadcast wia you encourage members of di public to burn down evri federal goment facilty for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment.
- Count 7: Say you Nnamdi Kanu import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra state.




