Trends-UK

Coup in Guinea-Bissau: Pesident Umaro Sissoco Embaló arrested by armed forcoup d’état

Wia dis foto come from, Patrick MEINHARDT / AFP via Getty Images

26 November 2025, 15:03 WAT

New Informate 29 minutes wey don pass

Some armed men don arrest Guinea-Bissau president Umaro Sissoco Embaló for wetin be like coup for di capital Bissau.

Dis dey come three days afta di presidential election vote wia im main opposition don dey disqualified.

Witnesses say dem hear gunshots for di capital around 1pm local time, but e neva clear who dey involved for di shooting.

Embalo bin take part for di 23 November 2025 presidential and legislative elections wia e cast im vote for Nema 1 for Gabu area of Guinea-Bissau.

Guinea-Bissau get population of about 2.2 million and na one of di West Africa kontris wey dey part of di Portuguese Empire for centuries bifor.

One goment official tell di BBC say she dey for her home wey no dey far from di presidential palace and dey hear gunshots.

Incumbent President Umaro Sissoco Embalo dey compete against top challenger Fernando Dias, and di two of dem dey claim victory for di first round earlier dis week for di election.

Im main rival, opponent Fernando Dias, dey contest di results.

Dias dey supported by former Prime Minister Domingos Simoes Pereira wey dey barred from running wit di di main opposition party, di PAIGC.

PAIGC na di party wey lead to Guinea-Bissau independence, and di Pai Terra Ranka coalition, wey e lead bin bring togeda around ten political parties.

‎Di electoral commission promise to announce di final election results by Thursday, afta dem cut warning give voters, candidates, political parties, electoral coalitions, and di media against announcing any results.

Report say approximately half of Guinea-Bissau 2.2 million inhabitants dey eligible to vote and di voter turnout dey estimated at ova 65 per cent.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Guinea-Bissau president Umaro Cissoko Embaló

More about Guinea-Bissau

Dis no be di first time wey tok of coup go happun for Guinea-Bissau.

For media address wey im give dat, Embaló say di attackers try to kill am and im whole cabinet for goment palace.

Oga Embaló, wey be former army chief, win di December 2019 presidential election – but im face last-minute show-down wit parliament bifor e take office.

Meanwhile, di kontri dey heavily rely ontop foreign aids from international kontris.

For 2011, di EU bin suspend part of its aid to Guinea-Bissau becos of concerns ova govnance and di rule of law.

For 2012, di UN Security Council express concern say drug trafficking don increase for Guinea-Bissau.

Since dia independence for 1974, di West African state don experienced at least 10 attempted coups.

Guinea Bissau get history of political instability and don see only one democratically elected president, dat one na bifor Umaro Sissoco Embalo bin even come complete a full term.

Brief Profile of ‎Umaro Sissico Embalo

‎Umaro Sissico Embalo dey elected president of Guinea-Bissau for 2019.

For 2020, Former prime minister Umar Sissoco Embaló take ova office afta e win di presidential election to end 46 years of military rule.

By 2023, President Embaló dissolve di opposition-controlled parliament, less dan six months afta dem bin reconstitute am sake of a shootout, wey e describe as failed coup.

Embalo na di first president to dey elected for Guinea-Bissau witout di backing of PAIGC.

Di kontri don witness plenti coups since 1980, but since dat time reach now, dem still dey face instability.

Di pesin wey Embalo take ova from, Jose Mario Vaz, na di first elected leader since di army don a mutiny for 2012. And na im be di first to complete im term witout being overthrown.

Why coup dey happun for Africa

Anytime wey soldiers successfully carry out any coup dem dey blame on corruption.

Odas dey tok sey na sake of poverty and di need to unite di kontri.

“African kontris don get conditions wey dey common for coups, like poverty and poor economic performance.

“Wen coup happen for one kontri e dey make di tin happen for oda kontris,” Jonathan Powell tell BBC.

Dis research work wey cover 19 African kontris show 6 out 10 further confirming say corruption na major reason wey coup plotters dey give – e confirm wetin Powell tok.

According to one study, na 80 successful coups don happen for sub-Saharan Africa.

108 of coup attempt wey happen between 1956 and 2001 don fail, di report show.

Uganda, Côte d’Ivoire, Niger, Sierra Leone, Rwanda, Zimbabwe na some oda African kontris wey don experience coup.

Wit dis recent Guinea-Bissau mata, dem don join di likes of Niger, Burkina Faso and Mali wey dey face military rule.

Reporting by: Nicolas Négoce, Senior Reporter, BBC News

Additional reporting by: Adesola Ikulajolu, BBC News Pidgin

Related Articles

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Back to top button